Blogger news

Home » » AKPORS THE BRILLANT BOY

AKPORS THE BRILLANT BOY




Akpors :- Papa, See my result, Na me carry 3rd.
Papa Akpors :- Hahahaha, Akpors Akpors! Na now I know
say na me born you.
Akpors :- Shey I tell you na. All those time I dey carry 35th..Na the teachers dey do ojoro, They know say I too brilliant.
Papa Akpors :- I believe you my boy. Na now I fit buy that Bicycle wey you see for Papa Rukewe shop !
Akpors :- Papa na u biko. You get mouth pass BasketMouth.
Papa Akpors :- but, Who be the two idiots wey pass u sef Akpors?
Akpors :- Na one WIZARD wey be Isaac and one WITCH wey be Patience.
Papa Akpors :- No mind them, You go show them next term. But who you come pass na? I no say dem plenty and you no fit mention all of them, I just wan know how many of una dey class. 
Akpors :- Na just the three of us I don mention so na… Isaac, Patience and Me. Na just the three of us PRINCIPAL put for Elementary Class ‘F’ !!! 

Na im Akpors papa just land for floor, gboossa, faint o!!

0 comments:

Post a Comment

Like us on Facebook
Follow us on Twitter
Recommend us on Google Plus
Subscribe me on RSS